LOVE & WEB
Tina interrupts her "saint? Aunty Tade you fall my hand. Any man be saint for this life? Unless you never catch them o! I no go lie you, na madam dey feed her family with this work wey she dey do, Oga no get shishi! All the money wey madam keep for Oga madam account na e Oga madam dey spend ontop all this girls wey their leg be like chicken skin"
"AHHH!" Tade shouts while Tina continues "Madam just dey honour am with the head of the house title, na she gan gan be the head of the house, everything na Madam neck e dey, na why e pain her reach bone, na God save the girl, Madam for kill am"