LOVE & WEB
Tade shouts while Tina continues "Madam just dey honour am with the head of the house title, na she gan gan be the head of the house, everything na Madam neck e dey, na why e pain her reach bone, na God save the girl, Madam for kill am"
Tade comments disappointedly "Na only God sabi marriage and life wey dey perfect o, me wey I dey use her marriage beg God for my own! Marriage na overhyped rubbish, Make I continue my baby girl lifestyle" Tina laughs at Tade's comment "Because man no good e no mean say you no go marry. You go marry, born, come give yourself better life, invest for yourself and pikin, no send
man at all cos dem no send you. I don loose am finish, oya make we go wash am" Tade i